Seeking Greener pastures (4): My First Germo Christmas Holidays

School don close for d year, all man don go Christmas holidays. But, all the Naija people no travel go anywhere. We dey hustle to pay all the gbese when we use take come Germo. As for me, I never still get documents to hustle, so I dey house dey chop and sleep. All the thing when I see for oyinbo film about Christmas wen I dey Naija na film trick, e nor sweet as dem take show am for film. Snow dey fall scatter, cold wan  kill black man.

Instead of me to dey happy during Christmas, I dey sink inside depression. Snow dey fall pieces and German people no be d easiest people to make friends with. Na only wen dem don drink beer drunk dem dey speak their mind, either dem show u say dem be racist or dem go show u d nice part of them. But, during this period, people no even dey outside. Christmas for Germo na strictly with inner kacus family. And as I no get family for here, depression start to dey kick in slowly. I get access to all the basic things of life (internet, light, food, health care etc), yet loneliness wan finish me. Den I understand some of the beauty of Naija. We no get all the basic things, so many things dey wrong with the system. But, we dey show love to ourselves. I begin reason how Christmas dey pop for Naija, stranger go tidy u Jollof rice, position u beer and all man go dey happy. For Germo, if I hear say person buy u beer, talk less of give u food. Even when person invite u come their house come chop, u go carry your own food or drink. The people dey run solo things. Walahi, I sink into depression. All my mind just dey Naija.

Anytime u notice say person for d abroad dey call u regularly for video call or voice call, just know say we dey try find that connection to house, to get that feeling of home. Las las, me and my guy (Rahman) enter REWE (supermarket like shop rite) go tidy all the cheap cheap food stuff to take tidy jollof rice and chicken. Before I forget, as jjc when still dey convert every euro to Naira. Na d cheapest items we dey buy, we no dey think if d quality good or not, imagine say small can coke na 2 euros (1k), something when no even reach big Pepsi for Naija. Tahhh, I no dey even near coke or Pepsi product for REWE, strictly Ja product, that na d cheap levels. So, if any of ya family member from Germo buy Ja product send come Naija, just know say that guy no try for una at all.

I know say Naija no follow, but I quickly learn say money and basic amenities no fit replace human contact. My people mental illness na real problem and my first white Christmas for Germo na depression things. But I still dey hopeful say things go pick up.

I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.

Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka

Comments

Anonymous said…
Last last, our complaints don change!
Bimsee said…
Na wah o. Las Las home is best
Ayag said…
My brother, ajo koledabi Ile. Even me sef don dey feel am here
@chi, last year we organize small naija get together. So maybe we go invite u
bowelvis said…
Did waka get as e be ooo.. If no be prospect wet de there I for no even wan comot 9ja regardless as d economy be..but e no gel make person no see (learn) from d otherwise of the world..na local champee be that na!
Mezebu said…
Las las...No place like home 🏠
Anonymous said…
May all your future Christmas eves be happy, bright and full of joy - no matter where you celebrate it. Even Germans often feel lonely on Christmas...
Izols said…
I can relate to feeling left out in a foreign place without family though...
Frankie said…
E remind me of that Tekno line "As I hustle go abroad I go dey hurry to come back, and when I come back, I go dey hurry to go back"