Seeking Greener Pastures: First of all, Introduction

Seeking Greener Pastures: First of all, Introduction
Na so I enter Germo (Germany) on the 10thof December, 2016 from Lagos, Nigeria. I sidon for waiting area for Munich Airport dey chill for Rahman. Rahman na d naija guy wen dem link me up with. Becos I no sabi anybody for Germo. Wetin I first observe na as everywhere just clean scatter, compared to Muritala Airport. Cold full ground, but my second hand yaba winter jacket hold side. Eveywhere just dark suddenly, I sharply check time and time na just 5:30 pm. I begin reason wetin dey happen, weda my time wrong or na different time zone. Only to find out say during winter, night dey come faster than normal. All this while Rahman never still show, I reload my mtn line with GTB online bank to use call am. Oboy, 1k credit finish after three minutes call. I respect myself, sidon wait jeje.

Las las, Rahman show, the guy sef just land Germo two months ago. Naija still dey smell for im body. Na so the two of us enter road dey go him place. As we enter bus, nobody dey ask for ticket, dem just expect say all man go do the right thing. Rahman don give me him spare ticket. Na so we rough am reach him bus stop (Freising). Piss don full my body, as we come down I sharply start to find where I go piss. But, as JJC, I dey fear to piss carelessly; make dem no go arrest black man. Rahman say make we leave load for bus stop enter corner piss. I ask Rahman, dem no thief our bag. The guy laugh, he say dem no dey thief for here, say if pesin carry our load, e go be our people (African) or foreigner. E say Germo pesin no go thief our load. Na so we leave load go piss come back and true true nobody carry the load. We enter bus wen carry us reach him hostel.

Oboy, I see hostel, I trip die. Hostel dey like Games village for Eric Moore for Surulere, Lagos. I enter im room, e first knack me wifi password. He nor even fear say I go finish him data, my guy laugh me scatter. E say my guy, use internet, nothing dey happen, na unlimited. Only first day for Germo, I don dey see as basic things when people dey take pose for naija, na normal thing for here. Dat one ginger me, I begin imagine how the rest of the country go be. I sleep with plenty expectation of a better tomorrow.  


Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka

Comments

Really funny and unique writing style. It's really interesting to read this in Pidgin. πŸ˜…
Unknown said…
My dada don loose oh for your writing style....interesting experience
Bimsee said…
JJC like youπŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚
Data finish ko data finish ni
Shizo said…
U even fit sleep me I dey awake all through my first night because I dey fear say na dream I dey and if I close eye I fit wake up for naijaπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
Unknown said…
πŸ˜†πŸ˜…πŸ˜‚
Unknown said…
This is cool.... But guy I Don know u from way back as children that we were you be diehard... no matter the storm you would always breakthrough even when others do dey ture
Taiwo Insurance said…
Highly educating, exceptional use of grammar, bless up!!!
Anonymous said…
Wow nice update,I’m planning that as well,abeg shey the waka to Germo worth am at end broda?
Las las, e worth am. E good make man travel see as d world be. No matter how person tell u, e no dey like wen u take ur eye see am