Seeking Greener Pastures (7): Signing Player
Wen Bible talk say "Oluwa know d beginning and d end", I no really understand wetin e mean. According to Bible turkey (talk), Oluwa create Adam first, as HIM observe Adam doings during the first few days, Him see say Adam pin code no complete. Na dere Oluwa talk say e no make sense make man dey alone, na so Him arrange Eve to give Adam back up. Now, months don Waka pass, men don dey understand the German terrain, hustle dey go, school sef dey plum. But, man still no complete, boys begin reason how to sign player. For this tori, signing player mean say boys begin find how to get babe.
U see all that levels for Hollywood movie wen new guy show school or area, Sidon for back sit, den one or two babes come dey buy him style. My Pipo, if u do that one for here, na dat sit u go grow white hair. My guy Rahman no dey take player matter easy. As e land, every night e go make what's app calls to all d Naija girls (Risikat, Biliki, Ramota, etc). But, after some months, my guy realise say "dem no dey tell blind man say rain dey fall, na body message". My guy see say phone call and reality no be d same thing.

For here, every thing na online pattern. If u try dat Yaba way of calling girls and dragging dier hand. Walahi, na police station straight. Even to track babe for club no easy, first of all u be black man, d odds dey against u. Cos dem don reason all d black men as asylum (refugee) seekers. So, men enter the online platform. For d dating App, if u like d babe, u go swipe right and if u no like am, u swipe left. My Pipo, boys no dey ever swipe left, steady right. And after some swipes, dem go tell u to pay 10 euro (5k) for unlimited swipe in a month. Hmmmm, a whole 5k, for us that time 10 euro to much to pay for dating APP. My man Rahman don sign up for almost all d dating APP and site for Germany, yet, market never sell, no player even gree match us, talk less of to chat. He reach one time, u go begin think say d app no dey work. But e dey work, wen I reason back unto our levels then, I see say d pictures wen we upload dat time ehnn, Naija been dey smell/ ooze for our body, even with all d picture filter, dem go know say dis one just come.
One evening wen we gather dey gist the player matter, na so some oda Naija guys begin tell us their own experience. Chibuzor story na him burst all man screen guard. The guy dey get matches for d dating site, but once dem ask am which country e come from and e talk Naija, straight unmatching. Our people don cast for the zone, as a sharp Ibo boy, my guy repackage him market. Now e say wen him match d babes and dem ask am were e come from, my guy response na half Nigerian/ Seychelles. The guy don research the country pieces, him village sef na Mayland, Seychelles. Chibuzor say na dat format dey extend gist for am. Oboy, lesson of the evening, all man become half cast, some claim Nigerian/ American. If u know anybody address for America, men begin use am claim, "I am from New York, Bahamas, etc".
Finally my man (Rahman) sign player. But comma dey for d signing. If u see d player, she dey like 2 bedroom apartment, she plenty every where. But, my man no get choice, e manage am like that. For here, all those girls wen plenty, na black men dem dey follow. And most black guys dey either find document or just wan help their sef. D worse thing about this plenty girls, dem wan hold hand for public, do all d romance. And my guy no wan make people see am with d babe. No be say I get anything against girls wen plenty, na just say na lack of option come join both parties. After my man body come down, na dat time e remember say d girl too plenty (men, na dier way), e begin complain everyday, "everytime she wan make we do "spazieren" (spazieren mean make we go for walk/strolling, na strictly outside waka sha)". I no fit blame my guy sha, cos if u see as people go dey look u ehnnnn, dem go dey reason say "see dis black man, he wan collect paper", na pity eye dem go use look u. Well, for dis case my man just dey find companion. Meanawhila, other men dey look up to Rahman say e don upgrade, but dem no sabi d cross wey im carry. The day we come go d babe house go chop Jollof rice (Yes, jollof rice, d babe dey cook Naija food scatter). We see d girl, we come understand y my guy dey complain.
My Pipo, "hustle make u no follow babe out of condition". if u get friend for d abroad and every time na only voice call una dey take follow him whitee talk or d video call na only face dey show. Just know say d babe no fit enter video call, probably una go need connect HDMI cable to big screen to see her. All this na part of the Waka to seeking greener pastures.
Next time I go gist una about "na black I black, I no kill person"
Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka

I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.
Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka
Comments
Guy you are too funny.
I enjoy your blog die.
A big fan here.
You get bad mouth.
But signings dey very key aswear
Keep this up Bruh.