Seeking Greener Pastures (8): Na Black I Black, I no Kill Person
Growing for Naija, everybody wen I sabi na black man/ woman. If u dey find work or any type of assistance for Naija, na mostly man know man go help u. People dey get jobs and appointments based on say dem come from one tribe or d oda. For Naija we dey call am "MAN KNOW MAN" or as oyinbo call am "Nepotism". Dis levels no make sense and e don spoil plenty things for adugbo. But, e know ever pure for my mind say people go just look your colour take downgrade u. I don see am wella for American film, but I never dey d film personally. So wen I cross enter Germo, I see d film live, I even follow act for d film before my eye clear. No be film trick my people.
The thing about Germo be say nobody go knack u discrimination face to face, only some kind old school men. For here, the levels dey happen for different kind setting. Some dey happen for office settings, school settings and some dey happen even with eye contact. The discrimination get different levels, me don put them for two category. Official or Formal discrimination and informal discrimination.
Make I reason una d official pattern first, this na sha based on my experience, some people fit don get different experience. One of the advantage of Europe na say u fit cross enter anoda European country without visa. So, me and some other naija boys reason to enter Salzburg (Austria). Na like 2 hours by train from Munich, we tidy ticket cross carpet enter Salzburg. The town fine scatter, men don dey fire plenty picture based on social media things. People for bongo must know say boys don dey cross carpet enter other countries. We don tour d city wella, make sure say our train money no waste. As evening land, time don reach to enter Germo back. We begin waka go train station, all man just dey happy, dey collect picture from Rahman, na him phone Camera make sense pass. Na so we enter train sidon for one corner. 5 black men together for inside train, na that time u go know say "where two or more black men are gathered, searching or interrogation must follow". Out of nowhere four police fall out, dem just come straight to us. Dis people don dey track us since, no be mistake say dem just block us inside train. One of them come ask us "Ausweiß, bitte" (meaning make we show dem our ID or passport). My guys dem flash dem dier ID, but I no gree show my own ID. I tell d police make he go start from d begining of the train dey ask for everybody ID before i go show am my own. And me I stubborn wen e come to things like dis, the police begin tell me say dem been don check d other side, i no gree, i tell am say na because of our colour dem dey ask only us, for almost 30 minutes we dey drag d matter. Rahman and d oda boys dey tell me to shun d matter and flash dem my ID. Las las, i flash dem my ID. The thing about the official discrimination be say dem no go gree say na discrimination, dem go tell u say dem just dey do dier job and as per say dem be government agents, dem go win u.
During our early adventure to try sign player (read last post), boys try to enter club to link up with people. Na for dere I first experience d unofficial or informal discrimination. My people, even wen na only u (one black person) wan enter regular club, e no sure say dem go allow u enter, talk less of wen una don reach 5 or 6 people. That one na sure bouncing, na so 6 ( 4 guys and 2 babes) of us wen just come carry ourself go club, we don baff up, men don knack dier Christmas clothes. As we reach club, we stay for line to enter club. Gate fee na 10 euros, people just dey pay dey enter, only to reach our turn, bouncer say club don full. Shuuuuuuu, Rahman say no be people just enter now now, bouncer say club don full. Me no fit make noise, i just pam for back, because if u see d bouncer ehnnnnn. E sure me die say if dis wan slap me, my health insurance no go cover d damage. Na so we comot for line, and for our very before, people still dey pay enter. We begin find other clubs to go, all dis baff up cannot waste. As we reach d next club, boys don learn from d early experience. We begin draw formation of how we go enter club, even Jose Mourinho sef no do this kind formation to win champions league. Our formation that day na 1-2-1-2. First guy go alone, as him succeed enter, we wait for another 20 mins, 2 people ( 1 boy and 1 babe) follow up, them sef succeed. Na so we use formation succeed enter club. But, e still get some days wey be say d formation no go pure. Some formation require make we go as united nations before we go fit enter. Depending on the club, na so we go use draw formation.
My pipo, plenty other instances dey wen dis kind thing dey happen. But no be say everybody dey like dis, na make we just know say e dey happen. If to say our leaders use dier pin code make things plum. Nobody go dey here dey chop nonsense.
Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka
The thing about Germo be say nobody go knack u discrimination face to face, only some kind old school men. For here, the levels dey happen for different kind setting. Some dey happen for office settings, school settings and some dey happen even with eye contact. The discrimination get different levels, me don put them for two category. Official or Formal discrimination and informal discrimination.

During our early adventure to try sign player (read last post), boys try to enter club to link up with people. Na for dere I first experience d unofficial or informal discrimination. My people, even wen na only u (one black person) wan enter regular club, e no sure say dem go allow u enter, talk less of wen una don reach 5 or 6 people. That one na sure bouncing, na so 6 ( 4 guys and 2 babes) of us wen just come carry ourself go club, we don baff up, men don knack dier Christmas clothes. As we reach club, we stay for line to enter club. Gate fee na 10 euros, people just dey pay dey enter, only to reach our turn, bouncer say club don full. Shuuuuuuu, Rahman say no be people just enter now now, bouncer say club don full. Me no fit make noise, i just pam for back, because if u see d bouncer ehnnnnn. E sure me die say if dis wan slap me, my health insurance no go cover d damage. Na so we comot for line, and for our very before, people still dey pay enter. We begin find other clubs to go, all dis baff up cannot waste. As we reach d next club, boys don learn from d early experience. We begin draw formation of how we go enter club, even Jose Mourinho sef no do this kind formation to win champions league. Our formation that day na 1-2-1-2. First guy go alone, as him succeed enter, we wait for another 20 mins, 2 people ( 1 boy and 1 babe) follow up, them sef succeed. Na so we use formation succeed enter club. But, e still get some days wey be say d formation no go pure. Some formation require make we go as united nations before we go fit enter. Depending on the club, na so we go use draw formation.
My pipo, plenty other instances dey wen dis kind thing dey happen. But no be say everybody dey like dis, na make we just know say e dey happen. If to say our leaders use dier pin code make things plum. Nobody go dey here dey chop nonsense.
I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.

Comments