Seeking Greener Pastures (9): Accommodation levels and Scammers

I don dey live for Freising for 8 months now, the place na super dulling area. But, as per say na where my guy been get school accommodation, I pin down for there. The dulling part of small city for here na say e go limit your hustle. To blend inside system dey hard for small city, becos most people na locals and dem no dey really speak English like that. All the correct hustle na Munich e dey and e go take you over one hour to reach ur hustle location for Munich. On a good day, that na normal travel time wen I dey do from Surulere to Lekki wen I been dey Naija. But, as I don dey here and see say I fit position for Munich. I begin reason to find house for Munich.

Big city dey come with big money. Freising dry, but accommodation dey cheaper and a bit easier to find dan Munich. To get house for Munich hard pass to get job sef for Munich. And no be say e hard for just foreigners, even Germans dey find am hard to get house for Munich. Talk less of bloody foreigner like me. Even wen u manage see d house, e cost scatter. Small room dey cost 500-600 euro a month (200-240k). If u wan come rent full apartment, dat one mean say your shit don soft. Na d main reason y boyfriend and girlfriend dey live together for d abroad, d tin dey cheaper, free dat love gist. Dem dey split the bill 50/50, na dat part dey sweet for Oyinbo relationship (na joke I dey joke ooooo, I still gbadun our Naija babes way). Person go dey groove for Munich, because of say train to Freising dey close early, u go comot d groove dey go house. I don make up my mind say I must move go Munich.


I begin bomb application online to find place for Munich, nothing don pure. This period I been dey my guy place for Dusseldorf. Babat na veteran for Germany, na my guy from Unilag, e don dey Germany 7 years. Now, him shit don soft, e don get German kpali sef. But, if u hear him suffer, afraid go catch u to come d abroad. Some reply me for the house levels, but after I meet dem in person, dem sha bench me. For dis house matter for Germany, u must apply "C" caution, because scammers dey d town wella. Na so I receive one email say house dey available, d picture stew, d price sef make brain. But, wen I read d email, I smile and begin laugh, imagine say dem wan scam a whole"NAIJA BOY". Den even construct d email for German. I go translate d email to English make una get idea of dier format.
                   
            Hello,

My name is Ricarda, I receive an email of interest when renting my apartment, for further information please contact me at my personal email address ricarda@web.de
The apartment is available, quiet, has all facilities and utilities: TV, parking, laundry, air conditioning, high-speed Internet, pets are allowed.
The monthly rent is 535 Euro without additional costs.
I worked 8 years in Germany and I bought the apartment to stay with my family, but now I am back in Greece and will not stay there anymore, so I rent it out.
I would like more information about you, if you don't mind.

- How many people stay in the apartment?
- How long do you want to stay?
- Do you have a job? Or are you a student?
- How will you pay the rent?


Apology for my German is not very good.

See levels ooo my people, dem wan knack me scam for d abroad. Mesef play along with d guy, make I see as d matter dey go. I fire am sweet reply for German sef, tell am wetin him wan hear. D idiot don dey happy say maga go soon pay. D speed wen d guy dey take reply ehnnnn, u go fear. Now, d levels don reach d part were him want make I transfer money to am. D tori take style plenty, so I go continue d gist next week.

For more info on Germo schools, make una visit:
www.daad.de. Na dere all d tori for Germo school matter dey.

I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.

Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka


Comments

Adeniyi said…
Dem wan scam scammer?? 😂😂😂
Anonymous said…
Abeg yann us how student dey get their Kapli
Mezebu said…
My guy sey yarn us how student dey take get their kpali....lol
Na dat 1 dey important pass