Seeking Greener Pastures 10: Accommodation levels and Scammers (2)

Based on last week gist, Ricarda wan scam Naija boy based on my accommodation search. But, before I continue d gist. Make I tap una how I take know say dis Ricarda na scam. From d email, first red flag na wen Ricarda say make I contact am for him personal email address, Germo person no go tell u to contact am for personal email address wen una never even agree say him go give u house. Second red flag, for all the levels wen him say d house get 550 euros over cheap for that kind house for Munich. Then, once I see say him start to talk say him live for Germany before and now don move go back Greece, all this signs dey show u say him no go dey available in person to run d business.

So to continue d gist from last week, Ricarda don knack me email say make I wire am the caution fee money of 1100 euros, baba don give me foreign account number based on say him don tap me say him dey Greece now. When I ask am how I go get key and d house contract, baba say him and Air B n B na business associates, so once I don credit him account, him go give me d contact details of d Air BnB people no finish d business. Mesef tell am say that one make sense and I go wire d money within d next three days becos I need activate my German bank account first before I fit wire d money. 3 days pass Ricarda never see my alert, baba (Ricarda, for foreigners baba just be another way wen Naija people dey refer to man in general) wait another two days before him tap me email say he never get d coins. I apologise to am say make he no vex, say d process to activate d German account dey take longer dan I think. Ricarda say him understand, say him sef go through d same wahala wen him been dey Germo. I tell am say him fit give d house to somebody else since I don dey delay. Baba say no oooo, him just like me, say him believe say I go take care of d apartment wella, so him don turn don other people for d house. See format ooooo, I just dey laugh, scammer wan scam Naija boy. After another two days pass, na me come knack Ricarda format.

      Dear Ricarda
        Thank you for your patience, unfortunately I am required by d bank to make an additional 500      euros cash deposit before I will be able to gain access to my funds. Currently I am short of money and cannot afford such. I want to solicit your help, I will appreciate if you can lend me the 500 euros and at once the account is active, I will transfer the caution fee (1,100 euros) and your 500 euros you borrowed me. Just to express my gratitude for all you have done, I will add an extra 100 euros to say thank you. 

Looking forward to your positive response. 
Sam


Wen Ricarda reply, he change am for me oooo, say him no fit do that kind thing, say him just wan help me. So d best he fit do for me na to keep d house for me for another two weeks, say him believe say by then I go don sort out d bank wahala. By this time me don tire for d play play. I just send am one last email wen close d matter.

          Dear Ricarda
                   Hope you know I am Nigerian?. 

My people after that email, Ricarda no even reply me at all. Baba see say na bad market, him wan scam people wen get phd for dis thing. All this while I still dey bomb house levels and nothing solid don fall out.

Las las, one Naija guy give me connect for person wen wan sublet him place. The place cost die, 500 euro per month for one room and I go still pay another 500 euro for caution fee. But, as I no get choice and I don make up my mind to comot Freising, I collect d place like that. D guy even tell me say possibility dey say d rent go increase after two months. I say, no wam paddy man. Just give me house sha. The guy wen give me d place na from Pakistan, him name na Salim. After I wire the 1000 euro (400k Naira) to Salim account, I just dey see say my guy dey upload WhatsApp story, d guy just dey tour Europe. D tin just dey pain me, e dey use my money dey floss Europe. The sweet thing about the room wen him rent give me be say na Naija guys dey stay d second room, so d place just become Naija crib. Salim don come send me d address of the place, e drop d key with d Naija guy next door. As I see d address, d address click for my head. The place na student hostel. Student hostel no dey cost reach dat amount, I buzz d Naija guy (Chukwuma) wen hold d key to ask am how much him dey pay. Oboy, d original rent to 270 euro (108k Naira) and 250 euro for caution fee (100k Naira). But as me no get choice and I wan live for Munich, I lock up, take d place like that. Wen I finally move in, my Naija neighbours dem be correct guys Chukwuma and Ekene. We blend quick quick, d house dey sweet. Dem begin laugh me say Salim don use my money dey tour Europe. As Naija south south boy, I don activate plan as I go take chop Salim eye. I no go pay that 500 euro for second month.

As God dey do him things, Salim send me message say next month rent go increase to 550 euros. The guy dey use the rent for here dey pay for sweet crib for another place. Na so I clear my guy. I tell am say I no go even pay that 500 euro sef. E begin pour charge, I send am message for pidgin to let am know say I dey report ourself to the hostel people. And dem go collect d room from am, and mesef go pack comot, but him racket go cast. As my guy no understand pidgin, he call Chukwuma (my Naija neighbour). Chukwuma interpret am for d guy, Salim voice change, baba begin yarn peace talks. Chukwuma come become peace maker, we enter negotiation table, settle d matter. Na so I take renegotiate my rent.

For people wey wan come Germo sha for school, e dey very important make u apply for student hostel like 6 months before u show. Cos, d wait period dey tey well well. If u apply for room wey get bathroom and kitchen, u go nearly finish masters before ur turn reach. For sharp sharp response, e go pay make u apply for room wen dey share toilet and kitchen. No worry d thing clean scatter. And as for hustle matters, big city dey get more levels.



I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.

Comments

Anonymous said…
House 20 people, if you know, you know
Unknown said…
Nice story Bro. Please I need your help if you can but I don't mind you send my your WhatsApp number or you can email me maxwell.iwuamadi@gmail.com
Anonymous said…
Fantastic work sir, i just wish your stories are much longer
Unknown said…
I am not on IG .You give me your email bro or WhatsApp number (mine is +2348146468009 WhatsApp number ).please I am a Nigerian and a prospective student .
Miccoli said…
Finally.
I don refresh tire๐Ÿ˜€๐Ÿ˜€.
Keep the good work bro.
E go soon clear for us wey dey still work am.
Anonymous said…
Boss can u give me the site or how can i book for hostel pls send me a message ybanks02@gmail.com
Mezebu said…
Make sense bro...Nice 1 #prospective students can learn from this
Anonymous said…
Sharp guy, reping naija well