Seeking Greener Pastures 11: UMZUG

Now, men levels don dey soft for Germo, boys don stop to dey convert every euro to Naira. Mesef don dey buy food wen get brand name, dey manage kack some fresh clothes. As everyday dey pass, Naija smell dey reduce for my body. From JJC for Germo, I don begin gain ground small small for d land. Everyday, levels dey improve. I don dey link up with more Africans for Germo. The thing about d abroad and everything for this life na information. Wen info dey flow, every go stew, but wen no info, simple levels go turn JAMB. Info wen been dey flow for town na about UMZUG hustle. UMZUG na German word wen mean "MOVE". For Germo, wen people wan park comet house, park in or out go new office or even move things enter container, any levels wen get to do with moving na UMZUG.

Rahman don update boys how the UMZUG matter dey go, how we go take register and get UMZUG hustle. The sweet thing about Umzug hustle na say na cash in hand. For Germo, to see job wen na cash in hand nor easy like that. This people can follow rule scatter. If people dey make heaven based on following rules, na Germo people go full heaven. Everything for the country, dem must record am "Rahman shit and mess by 2pm, d shit weight, place and type of shit and mess". Na so Germo people dey, everything dey recorded. Once u don register, dem go dey send u email of UMZUG hustle everyday, if u see d Umzug hustle wen u believe say d timing and location go well for u. U go reply dem and if dem select u, u go get all d info for d job.


I don dey bomb Umzug hustle, but nothing don get belle yet. Na so one day wen I just pin down for house, my surest guy (Rahman) pass me Umzug hustle. Sometimes, u fit collect Umzug hustle and u no get time go run am, we go just pass am to anybody wen dey available. Rahman wipe me d details of d job. D job na to paint house. For Germo, if u dey pack comet house, u must

paint the house (apartment) back to the original colour. Dem don ask Rahman weda e get painting experience, as Naija people, una know d answer. He tell dem say e be professional painter sef. Na so I enter d place as professional painter. Me and three other guys na him go run d painting job.

Hustle begin, men begin paint. Me wen never even paint drawing book well, begin form professional painter. As I dey paint dey go, I dey hear d husband and wife dey gist for d Oda room. Piss come catch me, na him I waka go toilet. Shuuuuuuu!, wetin I see burst my screen guard. D husband and wife dey paint d Oda room. Oboy, dis people want make d job finish sharp sharp, so dem no go pay plenty money. Just so make una know,Na per hour dem dey pay (minimum 10 euro= 4k Naira), and we dey get like 30 mins break. For d break, Oboy, dem tidy boys enough pizza and drinks (wetin some people dey take toast babe for Lagos, chaiiiii!, poverty na bastard). And dem go still pay u for the break period. Na so I remember how wan bros for my area for Lagos go bring things from Germo come Naija. He go load all dis danfo bus with plenty things, as d goods land, e go arrange boys to come help am offload d bus. D bros can bugar, ehnnnnnn. E go begin yarn say "boys for Naija no wan hustle", say wen e dey Germo, e dey follow people wen dey load him container work, bla bla bla .............. My people, na now I understand y e dey follow dem load d container, e no wan pay money. Wetin dey pain me pass, na say after those boys, sometimes people papa don work for 5-6 hours, e go give dem 2,500 or highest 3k. Buy dem big Pepsi and Iya Togo rice, and dem go reason say e try for dem. My people, next time make una dey knack dem correct bill. If toh say na Germo u knack that 6 hours job, na cool 60 euro (24k) b dat, and most times dem go still knack u tips.

My people, next time anybody wan fry turkey (talk) give u about unto I dey enter street for abroad work cos I dey hard working. Tell am to hold him lips, common shatap ya mouth. Just so una know sef, most of all dis bed side fridge, bed, and some kind items wen our people dey import use come form levels for Naija. Na for outside Oyibo man dey abandon am, becos d money wen u go spend take rent motor to carry only fridge or sofa don almost reach money to buy new one.

My people, one love, I go knack una more tori next week. Abeg, if u enjoy d turkey (talk) wen I dey fry. Try use ur church/ mosque mind subscribe and share with oda people. So dat u go dey get new tori as e dey land. Till next time, bless up my Pipo.



Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka


Comments

__kendrix said…
Masterpiece... Keep them coming!!
Usualsuzpect said…
“Men wen never paint drawing book “..����
Nice 1
Miccoli said…
Correct tory as usual.
Abeg make I go buy poster colour and refresh my painting memory..
Hustle must pay😀😀
Obianuju said…
Well done !
Unknown said…
very interesting, as it is in the Kola that is how it is in gbanja, only for those who knows the meaning
Unknown said…
This story sweet die...ol'boy, if you still dey Germo, DM for Insta at @ayowalesho ...I wanna buy you beer and make we go froove some
Mezebu said…
👍👍👍👍
Anonymous said…
🔥🔥🔥