Seeking Greener Pastures: Sack letter and Self Employment (12)
As I predict, Munich go well for hustle. E never reach one month wen I park enter Munich, I don see better fresh hustle. Sharp sharp, I bench Karo and bicycle hustle. My levels come dey soft small small. The new place wen I move enter make plenty brain, based on say na Naija quarters. The new fresh hustle na for Amazon, compared to Karo and bicycle, this wan na stew job. Na even d igbo elder state man from Karo knack me d pass. That guy na veteran hustler for Europe, e don hustle from UK-Poland-Denmark and now Germo. The Amazon job na summer holiday job for three months, this period Amazon dey get plenty work, so dem need more people to work and I no go lie d coins at the end of the month make brain, dat na even after Germo government don collect dier tax.
We do plenty screening and paper submission for d work, dem even say make I do police clearance. Wen dem tell me police clearance, I no go lie my mind cut becos of the train fine wen dem be don knack me, i even begin reason some nights wen i piss for corner, weda camera catch me, nothing wen no cross my mind, becos for Germo after God, na police. Tension wan pieces me as I dey wait the result. The police clearance dey take like one week plus before e go show. But, Amazon give me one month to submit d levels. I don dey work dey go, even claim first salary, d salary motivate me to hustle scatter.
All dis while police clearance never show, so I decide to go find out wetin dey delay d pattern. Although say I been don pay d fine for d train levels, fear still dey grip me. Make dem no go lock me for prison and my mama go think say I don forget dem, not knowing say I dey inside German prison. I sha build confidence go ask, dem clear me say dem dey return d letter back to the sender becos my name no dey d mail box. For Germo, if d letter u dey expect important, dem go only put am for box wen carry ur name or return am back. I call tire to tell dem to drop am for Salim box, becos na him name dey d box, dem still no drop am.

Na so Amazon call people wen never bring d letter to give us one week grace period. Finally, I get the letter a day before deadline. I open d letter with plenty fear, as i translate from German to English, dem say I pure pass Angel, dem say my record clean pass d snow wen dey fall for Germany. Next day wen be Friday, I submit d letter for my Oga hand. That weekend i don flex tight based on say summer hustle don stew.
Only for me to show work on Monday and my ID card no work, sometimes d tin dey happen like that. I go security go tap dem say my ID card no work, dem check wetin d problem be, after checking dem say make I give dem d ID card. I give dem, next thing dem tell me say dem don cancel my contract cos I submit the police clearance late. I explain to dem say I submit on d final day, security say nothin dem fit do. Make I dey go house, one thing wen I been don learn for Germo be say dem no dey beg. As dem don tell me say nothing dem fit do, even if my papa wen don die comot for grave come beg dem, nothing go change.
I lock up, begin reason wetin to do next. I buzz Rahman, tap am wetin just happen. Rahman tell me to go collect my jersey back from Karo. As for me, going back to Karo no be option. My brain just dey browse thinking.com. Wen I reason Salim house rent alone, after I don even threaten d guy. The moment I fail to pay, e go sharply pursue me, so him go give am to people wen him fit exploit. My people, wen I reason all my bills for d month, mesef know say "dem no dey tell blind man say rain dey fall, na body message" (meaning when u think of your problems, u would find a way to solve it).
My brain sharply arrange, I reason say accommodation na problem for Munich, plenty Naija people don dey fall in Germo and dem need somewhere to first put head. Na so I come up with "STOP GAP", I begin find short term accommodation for people, collect small commission. Morning till night, I go pin down on top computer dey find accommodation. I use d small money wen dey my account rent d place. Den I go spread d word out to all d Naija groups. Oboy, like play play, customers begin flow, my phone dey ring scatter. I turn number one house agent for Naija students wen need accommodation and even extend my service to dey help dem with city registration. Even though d money no reach Amazon hustle, but e pay all my bills for d month, even still give me small change to save join.
Las las, wen u think say one door close another one go open. This Munich wen I decide park come must show me love. And so far d place never disappoint me, things just dey look very promising. Till next week my people, Bless up.
For more info on Germo schools, make una visit:
www.daad.de. Na dere all d tori for Germo school matter dey.
Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka

I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.
Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka
Comments
Nice one bro��
I have someone coming to Munich in need of accommodation,is there a way to contact you so you can hook up