Seeking Greener Pastures: Helping JJC (15)
Everything for this life na turn by turn. Before, I be JJC for Germo and also co-tenant for my guy house. Now I don gain small ground for Germo, even become full tenant for my own house, don clear my Naija gbese wen I take enter Germo. Small small mesef don dey turn veteran for d abroad movement. Now e don reach wen mesef dey give advise to JJC dem.
As I port to Munich, d house rent plenty pass my power and I reason to find co-tenant to help reduce d bill. So I spread d word around town say I need co-tenant, as house na hot cake for Munich, e no tey, I don dey get plenty offers and I begin screen dem. Rahman been pass my contact to one guy for Naija wen dey come for him masters. I reason say since dis one just dey enter fresh, e go make sense make I consider over d people wen don already dey here. Based on say, from experience I no say e dey hard to settle inside d system without help. Na so I agree to collect Rahman guy for my place. The guy been still dey Naija, him been just dey wait to gather money buy plane ticket.
Finally coins complete for him hand, e buy ticket. My guy no fit wait to enter Germo, as usual e don call me like 1 million times to ask for things wen him suppose buy. I knack am d advise wen I sabi, I sha tell am make e no waste plenty money for clothes, just buy one winter jacket wen u go take land, cos wen u enter, him go see say all those winter jacket wen him buy for yaba no follow. But, Naija boys no dey hear word. Den go always believe say dem sabi clothes level.
Na so d day reach wen baba dey land Germo, I don go airport to go pick am. See me ooooo, mesef don dey go pick person for airport, just one year ago, Rahman sef come pick me for airport, now me don turn bros for Germo. As baba flight land, I position dey wait for arrival, I don spot my guy for line dey wait for immigration to clear am. Wen e reach my guy turn for immigration to clear am. I swear, e reach almost 45 minutes before immigration clear am, I don dey even fear say dem go send am go back Naija. Las las my guy cross immigration, as I see am, I come understand y immigration stop am for 45 minutes for questioning. If I say Naija dey smell for him body, I dey lie, dis one na Ado-Ekitti dey smell for him body, my guy kack woman winter jacket, to make matters worse, him come use abortion belt tight d thing. I sure say d immigration officers dey wonder say shey dis wan na refugee wen run from Naija. But dem no know say na graduate from Naija be dis. I don laugh tire wen I see d guy, as we enter train, I no fit hold myself again. Na him I tell am say "shey u know say na woman winter jacket be this?". My guy argue say na lie "dis na Zara jacket oooooo", e even buy three more jackets join. Una see y I talk say dem no dey hear word. I no follow am argue, as we finally reach my house, na so I tell am to kack d remaining jacket make I see, baba dey feel fly, I just call my Naija neighbours to come see our JJC. D way dem take laugh am ehn, I no need tell am say him mess up. My guy even buy female leggings thinking say na thermal wear (na trouser wen u fit wear before u knack d main trouser to prevent cold). The leggins even get shine shine on top. I reason say I no fit allow am go school like dis, before other boys go begin toast am, based on say dem reason am as gay. I give am one my jacket to use hold side. Na so we take end our JJC first night for Germo.
That same night, I follow one naija babe go carry my one and only WAFFI girl for bus station. She been don land some days ago, but she land for Frankfurt. So she come use bus from Frankfurt enter Munich. This my Waffi babe burst my screen guard wen she arrive, she kack up her naija winter jacket, at least na woman jacket she wear. As we carry her bags, she say cold plenty and she wan first comot her hand gloves to wear. Oboy, wetin my Waffi babe call winter gloves na oven gloves, as per say i no sabi her before, i just hold keep quiet and d other naija babe come clear her as e dey go.
The first three four days, na only eba my guy dey knack before e go school, him even carry sallah meat from Naija come. Dis wan na real local champion, na so I tell am say him fit drink cereal ooo. My guy answer funny die, e say cereal no go gauge him belle, na him make e dey fire eba every morning. I say ehnnn, na beg I beg am to drink cereal, finally e gree drink d cereal. But him own cereal drinking pattern na die. Baba put cereal, e pour small of d liquid milk, still mix am with plenty water. Chaiiiii, we don laugh tire, I tap am say, Oboy, u no need mix water with d cereal, just pour d milk like that. Hiannnn, my guy say y we go dey waste milk like dat nauu.
E take my guy time to adapt to d abroad system. But luckily for our JJC, things soft for am. E no even do plate washing based on say me and some other guys give am OT (orientation). If u see Ekiti boy and Waffi babe now ehnnnnn, dem don fresh like shrimp, weather don bring out the true "Brown Skin geh and Boy".
One thing wen I proud about for dis Munich, na say d Naija peeps wen I know sha, dey help each other wella. Incase men get plans to cross carpet enter Germo, I dey try tidy small youtube videos to give men vision on how to tidy d Waka.
Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka
As I port to Munich, d house rent plenty pass my power and I reason to find co-tenant to help reduce d bill. So I spread d word around town say I need co-tenant, as house na hot cake for Munich, e no tey, I don dey get plenty offers and I begin screen dem. Rahman been pass my contact to one guy for Naija wen dey come for him masters. I reason say since dis one just dey enter fresh, e go make sense make I consider over d people wen don already dey here. Based on say, from experience I no say e dey hard to settle inside d system without help. Na so I agree to collect Rahman guy for my place. The guy been still dey Naija, him been just dey wait to gather money buy plane ticket.
Finally coins complete for him hand, e buy ticket. My guy no fit wait to enter Germo, as usual e don call me like 1 million times to ask for things wen him suppose buy. I knack am d advise wen I sabi, I sha tell am make e no waste plenty money for clothes, just buy one winter jacket wen u go take land, cos wen u enter, him go see say all those winter jacket wen him buy for yaba no follow. But, Naija boys no dey hear word. Den go always believe say dem sabi clothes level.
![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEgmoUk_YbdSjM5NC2YoPP9h_SP7Apt5jn1BnFaxOrX1n1Fy9pYsujlDZlRtYIv_Ros-pT7l24dgFkaI3-7wfnvt8xrdqhvFcpeUdJxvg69wf2Bsfv_4vQTPkzETvMuoZLhNh44xP14rHHQ/s400/HelpingJJCSGP.jpg)
That same night, I follow one naija babe go carry my one and only WAFFI girl for bus station. She been don land some days ago, but she land for Frankfurt. So she come use bus from Frankfurt enter Munich. This my Waffi babe burst my screen guard wen she arrive, she kack up her naija winter jacket, at least na woman jacket she wear. As we carry her bags, she say cold plenty and she wan first comot her hand gloves to wear. Oboy, wetin my Waffi babe call winter gloves na oven gloves, as per say i no sabi her before, i just hold keep quiet and d other naija babe come clear her as e dey go.
The first three four days, na only eba my guy dey knack before e go school, him even carry sallah meat from Naija come. Dis wan na real local champion, na so I tell am say him fit drink cereal ooo. My guy answer funny die, e say cereal no go gauge him belle, na him make e dey fire eba every morning. I say ehnnn, na beg I beg am to drink cereal, finally e gree drink d cereal. But him own cereal drinking pattern na die. Baba put cereal, e pour small of d liquid milk, still mix am with plenty water. Chaiiiii, we don laugh tire, I tap am say, Oboy, u no need mix water with d cereal, just pour d milk like that. Hiannnn, my guy say y we go dey waste milk like dat nauu.
E take my guy time to adapt to d abroad system. But luckily for our JJC, things soft for am. E no even do plate washing based on say me and some other guys give am OT (orientation). If u see Ekiti boy and Waffi babe now ehnnnnn, dem don fresh like shrimp, weather don bring out the true "Brown Skin geh and Boy".
One thing wen I proud about for dis Munich, na say d Naija peeps wen I know sha, dey help each other wella. Incase men get plans to cross carpet enter Germo, I dey try tidy small youtube videos to give men vision on how to tidy d Waka.
I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.
Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka
For more info on Germo schools, make una visit:
www.daad.de. Na dere all d tori for Germo school matter dey.
Comments
You left us refreshing to no end last week.
Dope update as usual.
Twale
Serious ado-ekiti
Woman Jacket + Leggings 😁😁
Nice work as always