Seeking Greener Pastures: CURRICULUM VITAE (17)

Wen dem talk say human beings to get long throat, na just because every time we dey like upgrade or pursue new levels. Based on all d tori i don knack una, u sef go see say my levels don steady for d abroad. But, my eyes still dey chook for outside. My new house for Munich go well and I get Naija neighbors wen don turn my paddy dem. Na dis my Naija neighbors cos my long throat.

D sweet thing about schooling for Germo be say u fit dey work for correct companies as part time or even internship. Dis na very important leg work if u wan chop correct work after your masters. For here, nobody get time to ask u wetin u graduate with, na wetin u fit do dem dey interested in, which kind experience u get.

Back to how my Naija neighbors cos my long throat. The two of dem na students sef like me, but dem been dey work part time for international stew companies, no be say d coins wen dem been dey pay dem better pass wetin me dey collect. But na dat experience wen dem been dey get wen go well. D experience come even connect to wetin dem dey do for school. Just imagine weti
n dem go write for CV compared to person wen be say na only plate washing or bicycle work e do throughout masters. Na so my long throat start, mesef wan switch jobs to correct company, even if e mean say dem go pay me less money, i no mind, i don dey reason life after masters. Na so i start to apply for working student jobs. My naija neighbors even dey send me links of jobs wen dem believe say connect to wetin i dey do for school.

Oboy, my people to find better job nor easy. As i dey fire d job application, under 24 hours dem don reply me with rejection, shuuuuu, some dey even reject my application under one hour wen i apply. Most of d emails dey come in German, even though my German no follow, e get d key word wen I dey take know say dem don bounce me. Once u see LEIDER NICHT (UNFORTUNATELY) for d email, u no say na bouncing be that. D tin tire me, I even decide say i no apply again. My Naija neighbors still dey ginger me, one come decide to follow me do some applications, maybe i been dey do something wrong. Na dere breeze blow, fowl yansh come open. D guy see wetin i call CV, shake him head for me. E say no wonder dem dey knack me rejection steady, based on say for Naija CV no follow, my CV just dey anyhow. My guy come forward me him own CV. Oboy, if u see d guy CV ehnnnnn, make brain scatter. And na d German standard, na dere i take know say Germany been get dier own style for CV. I come begin organise my CV  for microsoft word, but d thing no easy to align well. D CV been still dey anyhow, luckily for me, one Ghana babe wen i explain my situation for just knack me one website wen go help u arrange your CV wella. D site go even give u suggestion of words wen u go fit use for CV.

Na dere my luck go start to change, Dis time my rejection dey come after one week or sometimes two. Some jobs even screen my CV enter second round. Even though say I never get proper interview, i just happy say i don dey make progress. After plenty plenty LEIDER NICHT email, i receive my first job interview email for one big international company for Germo. Dem tell me say I go first do phone interview make dem use know me better. Oboy, I happy like say i don even get d job sef.

I begin prepare for phone interview like say na call center job, dat period i just dey speak only English, make my pidgin nor go mix inside phone interview. Finally, phone interview dey come, remain small i for even wear suit for phone interview wen dem no fit see me. After 30 mins of plenty talk, d woman say dem go get back to me if i pass dis stage or not. My people from dat day ehnnnn, i just dey refresh my email staedy dey await email. 3 days after, d email finally drop, d news stew, dem don invite me for second round interview for their office. D interview tori get as e be, so I go update una d full levels for d next post.

My people, d people wen u surround urself with for d abroad dey determine how ur waka go be. Sometimes u go need sacrifice job wen go pay more money for job wen go give u better experience for future money. No loose guard, no stop to dey believe, just dey hustle steady, LAS LAS every every go pure.

For my videos and anybody wen wan DM me, my IG handle na: @samedein or @seeking_greener_pastures.


I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.

Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka


Comments

Whyk said…
Oboy if U wear suits for the phone interview, E go help U to put yourself in the right frame if mind. Just saying.
holy said…
PLEASE SEND ME THE NAME OF THE SITE TO DO THE CV BRO....ABEG! aaronnrealtor@gmail.com
Unknown said…
Please what is the site you used to organize your CV
Anonymous said…
Abeg drop name of the site wey you use
Feyiman said…
d people wen u surround urself with for d abroad dey determine how ur waka go be...
Oboy, dis yarnings gel well for anywhere. Even if I no fit see eye to eye, make you tanda for social media continue to dey keep tabs dey relate with mehn wey go add value to your life
Nice one brother..weldone. Make we reason am, why most of we Nigerians no dey won startup biz for hia? Na to just dey work work..? Make we reason am abeg. Cause some ppl na to become entrepreneur be dia call o.
Ola said…
Better talk!!! Abeg weytin be the name of the site wey you take run your CV? You fit send am to olayinkaoginni2016@gmail.com.
Thank you
Marto said…
Please what is the link to the site for the German cc snitram01@gmail.com