Seeking Greener Pastures: Naija Love vs German Love (16)
People wen get sense talk say "if u want something, make u continue to dey try until d levels get head". Na d levels wen my man follow based on trying to sign correct player wen sweet him mind. If u don follow d tori from before. U go remember the levels wen men follow just to get companion (post on signing player). Rahman no ever give up for this babe matter, the guy consistent for dis matter pass d masters degree wen him come pursue sef.
Rahman don finally free him former babe, based on say no be wetin him want. Baba sef wan follow model pattern babe. Na so my guy continue to dey hunt from different dating site, face to face for train, club, class, any avenue wen my guy get to take block babe, him no dey dull am. Some of dem dey give fake green light, but later men come understand fake and real green light for babe matter. For Germo, u fit meet correct barny(girl or babe) and she go dey over nice to u. Wen we first show from Naija, we go reason say d babe dey buy our style, u go begin follow up, dey form fresh boy dey talk wetin no follow join. Wen d babe go come burst ur screen guard na inside d gist, una fit dey talk about school matters or
place where u go like travel go, next thing she go just say "my boyfriend and I went there", SHUUUUUUUUUUU!!!!!!, so all d green light wen i read na fake, u go even vex say u don dey waste your time since dey talk to dis one. As we don come learn say no be as e dey go with Naija girl, e dey go with Germo babe, men sharply update server. Once we meet any Germo or white babe, we dey sharply ask if dem get bobo, so we no go dey waste effort.
Info wen come dey flow from our Naija/Seychelles broda na say e get one new dating site wen dey give men joy. Before d guy go drop d name of d site, Rahman don sharply enter d site. Only for my guy to see say e don join d site before, my guy don join so many dating site wen him no even if remember all of dem again. The good thing be say google help am remember all d username and password, so as him open d site, na even welcome back message dem knack am.
As my guy enter d home page, baba see say one stew barny don write am since, she even drop her number for my guy. Oboy, if u see d babe ehnnnnn, u go off, the barny na wetin dey give men diabetis, pikin sweet finish. We first even reason say na scam matters, but my guy tap am up for whats app, d thing start to flow. Rahman don hit jackpot, my guy dey overthink before e go send any message, my guy no wan misyarn. Na so dem arrange to meet. Rahman wen never barb hair since he come Germo enter barbing saloon go spend 11 euro (4000 naira) to fresh up, kack one sweet white hoody. If una see my guy ehnnnnnn, u no go believe am, baba clean scatter. Him don come reduce him name from Rahman to Ramie.
Na so committee of friends begin drop all d advice wen we sabi ontop one babe. Finally, d day show, my guy don go block him stew barny. Men position house dey wait feedback, d way we dey wait d gist, u go think say d babe agree to link us up with her friends. Victory for Rahman/ Ramie na victory for all of us. As my guy show house for night, na so e give us d gist, everything stew, my guy even kiss join, dem don schedule next meeting. That one sef give us hope say one day we go make ourself proud.
Three weeks don waka pass, baba dey feel good with him new Barny. Only for one morning to reach, d babe send my guy text say d levels no fit work. Just like that, all d sugar comot my guy body. Wen we begin question our star boy, we begin see where d stupid boy don scatter d whole levels.
Germo babes dey assess everything from scratch to finish, dem know dey talk wetin dem no mean. By the second time wen Rahman and d babe meet, my guy crash for her place and dem don run show. D stupid boy go dey apply Naija love pattern for Germo barny. Based on my guy orientation from Naija, him dey always claim "I LOVE U" once dem run show. Na so d idiot begin tell d girl i love u only one week after, just based on say dem run show. The babe tap my guy say "how u go love me now now?", so she tell am to calm down. For dis people, dem go fit don dey run show with u 6 months and dem never tap u "I LOVE U". Even after d babe tap my guy to calm down, d idiot no hear word, wen dem run show again two more times. D idiot tell her "I LOVE U" again. Wen we ask am y him tell her "I LOVE U?". My guy say na d normal way wen him dey tap babes for Naija wen him wan run shows, just to tell dem wetin dem wan hear. D girl begin reason say maybe dis one dey find another thing, cos dem no believe say u go just love person like that after una just meet three times, na so she take bench Ramie.
The thing touch my guy ooooo, e even wan beg d babe dat time. But, today if u see d kind babe wen Ramie dey with ehnnnnn, u go know say delay is not denial. Anything u dey pursue, just dey use morale follow up. Las las, every every go plum.
Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka

I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.
Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka
Comments
That one off me..