Seeking Greener Pastures: Veteran Experience and Advice (19)
Dem say wetin old man sidon see, even if small pikin climb tree e no go fit see am. Wen person wan make some kind waka, e dey always make sense make u tap small sense from people wen don dey d game. Wen I decide pursue Germo waka, I contact one of my guy from Unilag wen don tey for Germo. Him name na Babatunde, but we dey call am Babat for short.
Babat don dey Germo now 7 years, paddy man don stew now. But him journey rough scatter, dis na man wey be say him family collect Ajor for d whole Lagos state contribute make e enter d abroad. As i tap am say i wan enter Germo for school levels and i reason do MBA because i believe say business na my calling. Babat give me him story and dis turkey wen e fry give me follow clear me on to how to pursue school runs. Babat don run MBA for here, and my guy been no sabi say MBA for Germo require make e pay part of the school fees. So, wen my guy land and dem clear am about the school fees, him condition enter red, more gbese. Plus, Babat bin only get one year NYSC experience for WEMA bank, and MBA need correct work experience. Wen Babat go class and lecturer dey give case study, and people wen don work for Bank of America, PWC, Siemens and other international comapny dey answer, my guy not fit answer nothing, based on say him experience no follow. So him advice me say since i don dey education setting for Naija and get better experience, make i find course wen align with wetin i get experience with because for Germo na dat experience go help me find internship or working student job for company.
To make matters worse, Babat na d only black man for him class, and based on say e dey hustle to pay school fees and pay d gbese wen him family don collect for Lagos. My guy no dey go class regularly, steady hustle. Even wen e go class, d man rugged pass lagos conductor. Na d mokasin wen him dey rock from unilag e dey wear during winter. E bad reach d stage wey be say oyinbo come tell am say make e find better winter shoe, if not cold go kill am. D stupid boy no even pity himself, e go hustle finish, after e pay school fees and small gbese, e go dey send money give him girlfriend for Lagos. Las las, na another man come dey mantain d babe for Lagos. Based on him limited experience, Babat no even fit get internship or proper work experience wen go help am after d MBA.
So as expected, wen e finish d MBA, Germo government give am 18 months to find job wen dey connected to wetin e study. My guy apply scatter and no head way. 4 months to deadline of 18 months, my guy never get job, desperation don dey show. D only good thing wen be dey happen for am na saay e get one Germo babe.
As time dey run out, d babe tell Babat make dem go tidy marriage. At least dat one go keep Babat for d country. Na so my guy go do marriage with him babe, not knowing say na d greatest mistake wen him go make for him greener pasture hustle. My guy do marriage and since him no sabi speak Germo dat time. He sign papers wen go put am for bondage for the next three years, three years of external freedom but internal bondage.
D tori plenty and i go break am into mini series, so make una watch out for "THE INVINCIBLE ROPE." For my videos make una tap me up for IG: @samedein, @seeking_greener_pastures.
Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka
Babat don dey Germo now 7 years, paddy man don stew now. But him journey rough scatter, dis na man wey be say him family collect Ajor for d whole Lagos state contribute make e enter d abroad. As i tap am say i wan enter Germo for school levels and i reason do MBA because i believe say business na my calling. Babat give me him story and dis turkey wen e fry give me follow clear me on to how to pursue school runs. Babat don run MBA for here, and my guy been no sabi say MBA for Germo require make e pay part of the school fees. So, wen my guy land and dem clear am about the school fees, him condition enter red, more gbese. Plus, Babat bin only get one year NYSC experience for WEMA bank, and MBA need correct work experience. Wen Babat go class and lecturer dey give case study, and people wen don work for Bank of America, PWC, Siemens and other international comapny dey answer, my guy not fit answer nothing, based on say him experience no follow. So him advice me say since i don dey education setting for Naija and get better experience, make i find course wen align with wetin i get experience with because for Germo na dat experience go help me find internship or working student job for company.
![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjyO4SJweQbZzTuZYEb9h7ICcTFselmKj7NYvYb5Q39hwDg0CHF8BoergxLLp9xEPS1mIOyDwtYJws2lsZJtIsZ7adKYbpO2Lu1d3L_AWsdUD1LTmfOzrqOEh6EdFN-JjevMX3Rem5uSsg/s320/Veteran+Advice+SGP.jpg)
So as expected, wen e finish d MBA, Germo government give am 18 months to find job wen dey connected to wetin e study. My guy apply scatter and no head way. 4 months to deadline of 18 months, my guy never get job, desperation don dey show. D only good thing wen be dey happen for am na saay e get one Germo babe.
As time dey run out, d babe tell Babat make dem go tidy marriage. At least dat one go keep Babat for d country. Na so my guy go do marriage with him babe, not knowing say na d greatest mistake wen him go make for him greener pasture hustle. My guy do marriage and since him no sabi speak Germo dat time. He sign papers wen go put am for bondage for the next three years, three years of external freedom but internal bondage.
D tori plenty and i go break am into mini series, so make una watch out for "THE INVINCIBLE ROPE." For my videos make una tap me up for IG: @samedein, @seeking_greener_pastures.
I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.

Comments