Corona Break: Invincible Rope 3

 My people, make una no vex say i just off without generator. The Corona vilus don change the pattern for dis zones. E no easy at all, if toh say e easy, Ezekiel sef for enter new testament. But still on still we dey rugged the matters. 

The last gist wen i drop na as Soji dey try find him bearing for the abroad. Soji don finally meet Katarina parents and him don see as e dey go. The relationship dey plum and my guy don dey make small progress for the abroad. But, for the school matters, Soji still dey carry last. As per say na MBA Soji come run for Germo, him go need pay school fees and dat one mean say my man must double him hustle. Based on say na small town Soji school dey, plenty hustle no too dey like dat and d hustle wen dey go need make u sabi speak German. Shi shi German my guy no fit speak. Everything just dey against Soji on the hustle levels, black man for small village wen no sabi speak German. Back then most of the black people for dat village na refugees, so immediately dem see Soji, dem don dey reason refugee. 

Gbese for school fees dey increase, Lagos people don dey chance Soji papa and mama for their money wen dem borrow dem. As e be for dat period, Soji don stop to dey answer any call from naija. My guy nor fit focus for d school work, every every just rough like Lagos/ Ore road for my guy. If nor be Katarina, my guy go dey sleep for train station. D babe even buy my guy new winter shoe, as e still dey rock d Mokasin wen e get from naija. 


Las las, my guy finally get d abroad starter pack job wen no need German AKA plate washing. D way Soji dey handle d plate/pot washing ehnnnn, d people dey trip. Serious passion for d work, na so dem increase my man shift. Small small Soji don dey get him bearing small small, but school work still dey suffer cos my man dey work scatter to meet up with d bills. The oyinbo lecturers and students just dey reason say dis black man no just get sense. Soji go dey sleep for class, nobody sef wan follow d guy dey for group work. But Soji no get dier time as na only am sabi d load him carry for head. 

As my guy see say him no fit meet up with the school matters, him go apply for semester break. So him go fit just use the next 6 months focus on hustle, then resume for d next semester with less gbese. Luckily for am, enough plate/ pot dey for am to wash. As Soji don dey get him bearing, another gbege don dey set from Katarina side.

I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.

Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka


Comments

Whyk said…
Hope say this gbese from Katrina side no be belle things.
Trailblazer said…
Nice one. Hmmm which kind Gbege come dey shelle for Katarina nah?
Samaras said…
Omor make Katarina matter no be like water way pass garri ooo...as long as say OLUWA is involved..Soji ship sail well
DiarisGod said…
Always looking forward to this read