Invincible Rope 4
If toh say dem dey give award for best hustler in the past 6 months, na Soji go carry 1st, 2nd and 3rd. The man don use d semester break wey e take from school hustle die. For Germo school, u fit just give dem one or two lamba about ya situation and u dem go allow u take d semester off. For Soji, d lamba wen him throw na say he get family gobe for naija and e dey affect am bad bad. Oyinbo man nor dey take all those kain thing play, sharp sharp dem grant am semester off. My guy don hussle scarrer, e come jam one Waffi family wen come dey update am some kain side job wey dem go pay am direct cash. Mama Rukewe dey even tidy Soji better Banga soup and starch.
As d new semester wan start, baba don balance wella. E get d way u go baff up ehnnn, u go get confidence to enter anywhere. Na so Soji take dey baff up dey enter school. Soji wey nor dey put him pisure for whatsapp sef, com start to dey upload pisure. Before now, na only pisure of oyinbo environment Soji dey put for whatsapp, cos him sef no say dat time Abule-ijesha still dey smell for him pisure. As baba bounce enter class for first day, all man think say na new student don come ooo. People wey nor dey greet my paddy man start to dey greet am, hian Soji sef trip nau. Walahi, 6 months ago, pesin nor fit tell wetin be Soji real face color. Baba face na dey like small rainbow. But now the real brown skin boy don fall out, baba fresh like fish wen dem just casshh from water. Soji don even upgrade from d desktop wey e dey call laptop to wetin oyinbo dey call laptop.
As d semester dey go, baba dey do every every properly. E come reach time make dem do group project, my people nobody gree join Soji for group ooooo. But e nor suprise Soji again, cos e nor say dem dey reason am less less for d class. Baba tap d lecturer say him wan run d project solo, d lecturer say no wam. Wen time reach make all man submit their project, paddy man don submit even earlier dan d deadline. Na so d lecturer finish class, tell Soji say make him block am for him office make dem sharply chew turkey. My man bounce enter lecturer office to go hear d turkey wen e wan fry give am. Lecturer first hail am say d work wey e submit get plenty muscle, Soji form humble smith dey tell am thank you sir. Na dere baba fry turkey wen burst Soji screen guard.
Lecturer: Soji, who u pay to tidy this project for u?
Soji: Ahan, Mr Lecturer na me tidy my work myself nau.
Lecturer: Oboy, nor dey lie for me. All of us know say pesin like u nor fit run kain standard work.
Soji: Mr Lecturer, wetin u mean say "Pesin like me"?
Lecturer: Never mind, i go just review d work and get back to u.
Soji just vex, knack out from d man office. Himsef know say d man dey reason say black man nor fit tidy work wen standard like dat. My man just begin reason plenty plenty, him head don full. E just lock up say make e go house go jam him babe, at least dat side dey give am joy. Katarina and Soji been suppose go her parents side again, only for Katarina to talk say dem no dey go dere again. Baba ask her, wetin dey sup? Katarina say her parents tap say dem think say she nor serious with am, but 6 months don pass and dem still dey run show. Soji reply her say: how dat come be problem? Katarina nor wan open mouth talk d thing fully. As she dey dribble go back and front, Soji don use him pin code understand say skin color don become problem again. My man just tire for d whole levels, but Katarina let am know say she galant for him side like Aso Rock. Las las, baba just go Mama Rukewe place go chop yellow soup and starch.
My people, dis life nor balance. When Soji dey miss class and dey fail for school, lecturer dey tell am to work hard, dey form technical adviser. Now wen baba don upgrade him pin code, dem say how black man go fit submit work wen get 6 packs. My people, as I dey follow una talk like dis so, na d matter wey d whole world dey try settle.
Abeg, if u dey feel d gist, use ya church/ mosque mind comment and share am to other people. Na d feedback dey epp ginger d movement.
Comments
Sha, na black we black, we no kee pesin!
Fire down commissioner of entertainment.
3 gbosa for u boss. O po po gan (OPG) meaning "U too much"