Seeking Greener Pastures (5):The Hustle Begins

New year, fresh expectations, plenty resolutions but same old gbese from last year. The German waka involve enough borrowing, and as expected, peole for Naija dey bell me steady for dier bar. The first good news for 2017 na say foreign office don finally knack me jersey number to enter street, all documents signed and sealed. I don become licenced hustler for Deutchland (Germany). 

As expected, I begin find job every angle, na that time u go know say German language important. Some people no go even follow u buzz cos u no sabi speak German. So I begin find jobs when no need German language, even that one sef hard to see, no be say e really hard to find. When u be jjc and your guys sef na jjc like u, information go dey very limited. So I been dey operate based on the info wen my guys get. All them dey signed up to one agency popularly known as Karo (Karolina). Karo na d name of the woman wen dey run d agency. She dey sign people to go work for different hotels and companies. When I say hotel and companies, I no mean say we dey do office work. Na serious plate washing business, some men hold record for plate washing. Some boys get steady jersey for some centers, if dem dey give u Allianz Arena (Bayern Munich Stadium) that means u na professional plate washers, although say d plate washing na with machine. But, imagine say person dey wash plate for 10 hours straight. And that 10 hours plate washing no enter 100 euros. So if u see some people dey pose for social media say dem go watch football match, tell dem make dem snap their complete outfit and other people for the stadium with them. As I dey talk sha, even the almighty Karo talk say space no dey for me to join the plate washing hustle. I enter Mcdonald, Burger King, Kfc, all of dem bench me. 

Las las, I come see delivery job with bicycle, this wan na uber of food delivery. See as I dey happy like idiot on top this job. I enter d office, dem knack me my complete kit, show me how d app dey work. As my gbese dey wait me for Naija, I sharply enter street to hustle. My broda, anybody wen tell u say e easy, na set up oooo. When I ride bicycle for one week (5 hours a day) my body tell me. One day I snap picture, if u see as my neck dry like Osterich own ehnnn, choiiii, I pity myself. But wetin man go do, gbese and bills dey to pay. On one of d days wen I go work, if u see d snow when dey fall ehnnn, na dt time all this wicked people come dey order plenty food. I ride go deliver for one far place, climb stairs up to the 6thfloor, form smiling so levels go drop. This customer look me tell me DankeschΓΆn (Thank you very much), not even 50 cent for tips. Snow don beat me, body don wet like chicken and shi shi she no dey drop, d way I take give her 0 star for rating, writing long epistle against the woman, u go think say we don get problem before. And just make una know, tipping na normal for this zones. That month wen coins hit my account, I pay rent, pay health insurance, pay gbese, tidy food and one or two levels, coins don finish. Money no reach, man need add extra hustle. Na so almighty Karo knack me call up, give me jersey for d plate washing business. And guess what, my first assignment, almighty Allianz Arena. 10 hours marathon of plate washing. I kack up on match day, reach stadium, enter the kitchen. Oboy! Kitchen dey like stadium, na only Africans/india/Pakistan people dey d kitchen, see men wen be elder for east (igbo land Nigeria) dey wash plate like say na PhD thesis. As I enter, d supervisor knack me shower cap to cover hair, give me safety boot wen heavy pass Julius berger construction boot. I no dey exaggerate, I wash plate for complete 10 hours with only 30 mins break, d plate no dey finish. Na so d igbo elder state man say make I knack am video as e dey wash d plate, I ask am y u want this kind video? Him reply make me laugh scatter, he say anytime e send money to him wife for Naija and she say only 100 euros, e go send her that video make she see as e dey hustle. 

My People, if pesin send u coins from d abroad, appreciate am die, cos d hustle no be here. Las las all of us go dey alright. 

Comments

Unknown said…
If u come to Munich, Allianz Arena job na u go do as student, no two ways about that.
Mr. Wee said…
That elder, na the real MVP, lmao.
Las las, no situation de permanent, e go better my broda. Looking forward to next week’s revelation.
Whyk Mr magic said…
Bros, when the flexing go start because this story suppose get happy ending.
Munascin said…
πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
Unknown said…
Ur story too funny buh its jus reality. Pesin wey neva come Europe hustle no go understand. Its not easy buh at d end we go all smile ☺.
Joseph Kunmi said…
Maybe I should write to this guys to come to Nigeria
Place like Guinness PLC
Where grace with msc as operator work for 13 straight hours
With just 3min to eat

1 and hour days off
You don't sit down
Machine must not stop

And month end you received 60k or 45k as salary

Because Nigerian are just suffering and smiling

You live at ikotun
Work at vi ontop 50k salary

Wake up, 4am get up 10-11pm

And at end all this work , you can't buy a bike

His schooling free, he has better prospect with the Germany cert
And hope

My brother , am living experience of what I wrote

His message to me doesn't make sense to me

The Germany
We go go
We go survive
If he think Germany is hardwork make he go Nigeria or dubai
@joseph, I no argue d hustle for naija. I just dey share my experience for d abroad. I no Dey try compare.
Don said…
Bridal, the hustle is real. Who no go no go know wetin guys dey see for this bongo!!
Don said…
Broda, the hustle is real. Who no go no go know wetin guys dey see for this bongo!!
Anonymous said…
I can relate to this... Cos my brother stand as a security for more than 10hrs a day in US and all his friends in Nigeria keep billing him, atimes when i do video call with him i pity him... but thank God he is starting school this winter the stress will reduce cos he has hustled alot to give himself rest
Kris said…
Nice write up
Anonymous said…
Nice one bro. Ain’t easy in the abroad
Anonymous said…
πŸ‘πŸ»πŸ‘πŸ»πŸ‘πŸ»
Inside_Life said…
@Joseph Kunmi.. If you find it difficult to understand the point of view of the writer, I wonder how you intend to cope while studying in a developed country. You completely missed the whole point of the story.
The writer hasn't invalidated the struggles of living in a developing country, he's only narrating the realities of living "abroad". While living 'abroad' looks all shiny and fancy, it's not all that rosy.
CAPISCE?
Anonymous said…
Omo all the Waka no easy o, boys sef dey reason enter the Waka soon, but after everything the Waka still make sense abi, or make man no try am?
Anonymous said…
In side life