Seeking Greener Pastures: Stew season and Oktoberfest (14)
![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEj_NI1cac3JDKnNE2gLWJwshwS02Z7uD4xdBlb2hm3ILUBHdTl1FJ-ebDBCQrJIo9Kf82q2LGSYnyBK7DV_BkpYz12r8u6_v36ezmosAxDdkayWNexA_nChYJJQ4Fy1Q-eDvz9NMHiNfUE/s320/TenancyAgreementseekinggreenerpastures.jpg)
If u dey watch Bundesliga well well, u go notice say na beer dem dey take celebrate who win league or any sport competition generally. Dat na becos for Germo beer na d official levels. U fit wake up for mor mor take beer brush mouth. Even me wen be no dey drink beer for Naija, i join d levels wen i enter Germo, i sure say if my mama dey read dis post, she go say i don join bad gang. For Germo, beer cheap pass water, even babes dey down beer wella, dat one no mean say she be bad girl. Dem get different brands of beer, so all man go see him brand, non alcohlic beer sef dey. Germo as a country dey tidy beer steady, but Munich na d beer capital. Every year, for two weeks dem dey celebrate d biggest beer festival (Oktoberfest) in d world.
![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEhyCiu9VIfLDL5H13jLnaNkloXhrG37TO3opk_vVKFb_TI-EsAWQDpykN656N6DnEJuCxgT2QtPVVxSO3mxf3K4R7CmeXoDpfEBS_R5lmmugivKI4rmnmfh4FXsUrDEIq_BjeUYELQJhjg/s320/OktoberfestSeekingGreenerPastures.jpg)
Dis year sha, as i don dey work for dis hotel, my colleagues dem go well, d place dey like my small family for Germo. Steady dem dey organise event wen we dey do together, as Oktoberfest reach, dem don arrange day wen we go enter d levels, dem even make reservation. Because if u know make reservation, u nor go see space. Based on my before before experience, wen oyinbo man tell u "LETS GO FOR DRINKS", e mean say hold ya money. As na Oktoberfest period, everything cost die, 1 liter of beer wen dey go for 5 euro go turn 12 euro. As d day reach sha, me don hold my small beer money, we ball in, my colleagues dem no waste time, men don dey down beer, chop anything. Every 5 minutes dem go tell me to drink up, order another. Like say na dem go pay for me, i just dey knack dem excuse "I AM A SLOW DRINKER", me wen dey respect my pocket, another 10 mins, one stew babe come even order another beer for me. Shuuuuuu, and as na fine geh, i no wan fall my hand. I just tell her say i no wan drink plenty cos i never chop. Mumu like me, d geh say make i order food nau. Na so I stand up to comot, dis evil spirit geh dey monitor me sha. Na so she block me ooo, ask me where I dey go? I say I wan go collect money for ATM. Na dere d baby clear my doubt oo, she just tap me say; Sam: Everything you eat, drink or do is paid by the hotel, so eat and drink as much as you can. Na so my eyes and mouth open, no wonder my colleagues dem just dey drink and chop anyhow, ahhannn, i don dey dull since. Na dat time i come learn say companies for Munich dey carry dier employees go drink beer for Oktoberfest. I begin shayo and chop anything, i wan try catch up with my colleagues wen don dey shayo and chop since.
Omo, I high dat day, but i been still get my pin code. One thing wen different from Germo and Naija about shayo be say even wen u drunk, u go still behave yourself. Just because u drunk no mean say make u misbehave because police go still knack u fine. U know even fit ride scooter or bicycle wen u drunk. That period, I no dull am at all, anytime office say we dey go Oktoberfest, sharply i don dey dere over early, free shayo, food and enough side attractions (if u know u know).
I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.
Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka
For more info on Germo schools, make una visit:
www.daad.de. Na dere all d tori for Germo school matter dey.
Comments
Everywhere don stew for you and the thing dey totori me like say I dey flex with you 😂😂