Seeking Greener Pastures: Stew season and Oktoberfest (14)

Omo, anytime i reason as i take get my new job ehn, d levels dey still off my brain. This period i just believe say i fit do anything, enter anywhere. My morale high pass transformer, even binatone stabilizer nor fit drop my morale dis period. Based on d excess morale for my body, i begin reason which oda levels i fit use am run. I no even reason tey sef, my pin code go Salim accommodation levels, i don dey student accommodation waiting list dey go one year, and d house wen i apply for dey take 18-24 months before I go get am. Imagine by the time i wait 24 months, i go don finish d masters program wen i come do sef. But as ginger full my body, i burst in student accommodation people office. As I enter, i clear d woman as e dey go. She tell me say I still get at least 6 months to wait for accommodation. Abobby, I clear d woman say d place were I dey bunk currently na armed robber money i dey pay and i no fit keep up, make she just try coordinate for me. D woman collect my ID card, look computer, tap me say make i come next week come sign contract for house. Shuuuuuu!, so house dey since, una just dey make person wait sha. I over happy say mesef go soon turn official tenant for Germany. But, my spirit still push me to tell d woman say i no mind any accommodation, e no gas be d one wen i apply for. The woman do another computer magic, give me over stew response "Do you mind signing the contract today?". Oyinbo people can ask JAMB question oooo, sharp sharp I don sign contract, she even tap me house wen tap pass wetin i apply for. My people dis house dey like 1004 building, we even get cleaners, elevator, and d internet speed na die. This my ginger dey bring good result ooo. I sharply knack out of Salim house. But, I no tell am say i dey knack out, i just position d house to another naija babe wen just show Germo. Dis na d first official Waffi babe wen i know for Germo, finally I don see person wen come from my side of Naija. Dis waffi babe carry last wen she first show, just like every JJC. Na so I turn Salim place to official STOP GAP residence.

If u dey watch Bundesliga well well, u go notice say na beer dem dey take celebrate who win league or any sport competition generally. Dat na becos for Germo beer na d official levels. U fit wake up for mor mor take beer brush mouth. Even me wen be no dey drink beer for Naija, i join d levels wen i enter Germo, i sure say if my mama dey read dis post, she go say i don join bad gang. For Germo, beer cheap pass water, even babes dey down beer wella, dat one no mean say she be bad girl. Dem get different brands of beer, so all man go see him brand, non alcohlic beer sef dey. Germo as a country dey tidy beer steady, but Munich na d beer capital. Every year, for two weeks dem dey celebrate d biggest beer festival (Oktoberfest) in d world.

The levels start as wedding celebration of the Prince of Bavaria and him babe Therese 204 years ago. Dem come decide to dey tidy d celebration every year. The levels invlove steady beer drinking for two weeks (last week of September-1st week of October). Na only local beer wen dem tidy for Munich dem dey allow for d event, last year people drink 7.5 million gallons of beer.

Dis year sha, as i don dey work for dis hotel, my colleagues dem go well, d place dey like my small family for Germo. Steady dem dey organise event wen we dey do together, as Oktoberfest reach, dem don arrange day wen we go enter d levels, dem even make reservation. Because if u know make reservation, u nor go see space. Based on my before before experience, wen oyinbo man tell u "LETS GO FOR DRINKS", e mean say hold ya money. As na Oktoberfest period, everything cost die, 1 liter of beer wen dey go for 5 euro go turn 12 euro. As d day reach sha, me don hold my small beer money, we ball in, my colleagues dem no waste time, men don dey down beer, chop anything. Every 5 minutes dem go tell me to drink up, order another. Like say na dem go pay for me, i just dey knack dem excuse "I AM A SLOW DRINKER", me wen dey respect my pocket, another 10 mins, one stew babe come even order another beer for me. Shuuuuuu, and as na fine geh, i no wan fall my hand. I just tell her say i no wan drink plenty cos i never chop. Mumu like me, d geh say make i order food nau. Na so I stand up to comot, dis evil spirit geh dey monitor me sha. Na so she block me ooo, ask me where I dey go? I say I wan go collect money for ATM. Na dere d baby clear my doubt oo, she just tap me say; Sam: Everything you eat, drink or do is paid by the hotel, so eat and drink as much as you can.  Na so my eyes and mouth open, no wonder my colleagues dem just dey drink and chop anyhow, ahhannn, i don dey dull since. Na dat time i come learn say companies for Munich dey carry dier employees go drink beer for Oktoberfest. I begin shayo and chop anything, i wan try catch up with my colleagues wen don dey shayo and chop since.

Omo, I high dat day, but i been still get my pin code. One thing wen different from Germo and Naija about shayo be say even wen u drunk, u go still behave yourself. Just because u drunk no mean say make u misbehave because police go still knack u fine. U know even fit ride scooter or bicycle wen u drunk. That period, I no dull am at all, anytime office say we dey go Oktoberfest, sharply i don dey dere over early, free shayo, food and enough side attractions (if u know u know).


I appreciate all una comment. If e get tori wen u go like make I shine light ontop, knack am for comment section. I go do my best to reason d matters. Till next time. Bless up my pipo.

Tags: Nigerian in Germany; pidgin; Naija living in Germany; pidgin blog; schooling in Germany; German waka


For more info on Germo schools, make una visit:

www.daad.de. Na dere all d tori for Germo school matter dey.


Comments

Anonymous said…
Ur parade don Dey bam oo
Lekankesh said…
Your sheet don dey soft oh! See as everywhere stew for this story. Later you go come dey tell us say everywhere hard lol.
Miccoli said…
Man u dey gather ground.
Everywhere don stew for you and the thing dey totori me like say I dey flex with you 😂😂
@lekankesh, wen e hard, I yarn say e hard. Wen e stew, I confirm d stewness
Ayo said…
Lol . “Let’s go for drinks” means carry your own money 😁😁😁
Anonymous said…
I don dey gbadun your Tori all the way from Nigeria till I enter Germo too..But accommodation na problem for here oh, and man need to hustle. Kindly hit me up with this Umzug Hustle without permit now..
Mezebu said…
Good job bro 👏👏👏
Inside_Life said…
Everywhere stew... 😁
Anonymous said…
🔥🔥🔥