Skip to main content

Posts

Featured

Invincible Rope 4

 If toh say dem dey give award for best hustler in the past 6 months, na Soji go carry 1st, 2nd and 3rd. The man don use d semester break wey e take from school hustle die. For Germo school, u fit just give dem one or two lamba about ya situation and u dem go allow u take d semester off. For Soji, d lamba wen him throw na say he get family gobe for naija and e dey affect am bad bad. Oyinbo man nor dey take all those kain thing play, sharp sharp dem grant am semester off. My guy don hussle scarrer, e come jam one Waffi family wen come dey update am some kain side job wey dem go pay am direct cash. Mama Rukewe dey even tidy Soji better Banga soup and starch.  As d new semester wan start, baba don balance wella. E get d way u go baff up ehnnn, u go get confidence to enter anywhere. Na so Soji take dey baff up dey enter school. Soji wey nor dey put him pisure for whatsapp sef, com start to dey upload pisure. Before now, na only pisure of oyinbo environment Soji dey put for whatsap...

Latest posts

Corona Break: Invincible Rope 3

Invincible Rope 2

Invisible Rope 1

Seeking Greener Pastures: Man no Man (Ima Madu), End Game (20)

Seeking Greener Pastures: Veteran Experience and Advice (19)

Seeking Greener Pastures: Interview (18)

Seeking Greener Pastures: CURRICULUM VITAE (17)

Seeking Greener Pastures: Naija Love vs German Love (16)

Seeking Greener Pastures: Helping JJC (15)

Seeking Greener Pastures: Stew season and Oktoberfest (14)